This na awa Exclusive Interview wit Mr Peter Obi, di running mate to the Peoples Democratic Party presidential candidate Atiku Abubakar in the 2019 election, On top the show way we call “The Sheet Political”, Mr Peter Obi tok many many tinz way concern awa kontri economy and leadership. Oya Enjoy, share am and abeg tell us wetin u tink.
Mr Peter Obi na Naija politician and him bi former governor of Anambra State way serve from 17 March 2006 to 2 November 2006, when dem impeach am and from 9 February 2007 to 29 May 2007 after dem cancel di impeachment.
Na graduate of both international and national institutions like the Lagos Business School; Harvard Business School; London School of Economics; Columbia Business School; Institute of Management, Switzerland; Kellogg Graduate School; Oxford University and Cambridge University.
E get one time sef way him bi de Presidential Economic Management Team; Vice-Chairman, Nigeria Governors’ Forum; Chairman, South-East Governors’ Forum, and the Governor of Anambra State. Oga Peter Obi na correct professional way don leave good examples for pipo to folo across di corporate world.
Na him bi di most humble Naija politician? Well, make you bi di judge as you WATCH am tok about how;
- I leave ₦75billion investment, ₦30billion in cash and oyinbo currencies for Anambra State when I leave office as Governor
- Peter Obi speaks on being Atiku's VP candidate
- Where I Stand On Biafra/IPOB Matter
- Na the ONLY way Nigeria fit carry our people comot from poverty be dis
- Na the elites be the problem of Nigeria because dem dey benefit from the confusion
- Bad Pipo too Plenty pass Good Pipo for Naija Politics
NB: Dis interview with Mr Peter Obi happen before dem announce am as running mate to Atiku Abubakar.
As E Dey Go: We enta street go ask Lagosians dis kwetion and deir reply dey very interesting.
“Wetin your bank don do for you wey you no fit forget?”
Click Here make you watch am.
“Nairametrics Money” way come with deep deep infomate about wetin dey happen for we stock market and awa economic sector, WATCH how Dr Ola Brown, Tunji Andrews and Ugo Obi-Chukwu take scatter mata on top;
Check out previous episodes of “The Sheet Political” like Festus Keyamo, Kingsley Moghalu and all di Ogbonge Videos on top YouTube.com/TheSheetTV and you even fit folo us on our social media channels. Make u enjoy Ur day o!!!
No comments